Tuesday 25 June 2013

Pictures : pls save OJB

1170236__20_music_20SUGAR20_320IMMACULATE2020_music_20_1_jpg70020d974245005d084c67ece1ee5c74
Some entertainers and group media friends go visit producer Ojb Jezreel for him house at No 4, Gbaja street, surulere on Monday June 24, 2013.


The support wey people dey give Ojb don increase so tay fans and colleagues don dey try their best to donate wetin dem fit donate, and they also visit the Singer/producer for him house in Surulere.

Some of them come donate , some just wan come visit am just to know how e dey go for am , vector na him we see say him dey pray for the ailing singer/producer . E neva too tay wey Don Jazzy donate N1 million to help OJB raise the money for him kidney problem. 

People wey come visit OJB for him house na Vector, Yemi Alade, Dj Jimmy Jatt, Jaywon, Kag, Mr Cool and other people .
@9jawetindey prayer be say make God send am help from above and make divine healing be him portion.

OJB & WifeVector Praying For OJB


0 comments:

Post a Comment