Friday 21 June 2013

Relationship tips: how to ask a guy out

JUST DO AM

 

men dey feel am when woman ask dem out, e dey make our head swell most times especially if the girl fine pieces lol... we sabi say no be easy task but e go give woman edge for inside relationship.

you fit buy drink give am for club.

If na for inside club you reason say one guy dey eye from one corner, you fit just send bar man make him give am drink, the bar man for don see wetin dey him table, but no go dey do pass yoursf o!!. make woman sef take charge, no be by mouth talk be gender equality. dis kyn tin dey trip man, e go sabi say the girl no be 'ebinna' ...

suggest say make una hangout

no be say u go come carry am go your room o! well, if na so you want am then notin do you. we suggest say make you just try carry am go somehwere were una go fit gist, una fit gather go viewing center for weekend if the guy na football fanatic...

make him sabi your friends

but you must dey carefull oo! all those your single friends wey no get your joy fit carry your new catch go oo! at the same time no go dey do 'close marking', you must allow make everything dey natural so the guy no go dey look you like 'do or die' girl, guys no like am.

allow make the guy finish the whole matta

no go dey tink say because say na you initiate sometin , the guy go allow make you dey lead am dey go. man like to dey in charge so you must give am chance to take him position, make him sef suggest some kyn activities of which e fit be bedroom tins but still on still, allow him to be a man.. him don already sabi where everything dey go.

0 comments:

Post a Comment