Thursday 20 June 2013

Lionel Messi and him Papa fit go jail unto tax fraud

judge don summon messi unto £3.4 million dollar tax fraud!!!!

we hear say Messi fit go jail unto tax fraud and them do summon am to court for Barcelona. Tax authorities for Spain don accuse Messi and him Papa say dem defraud dem for money wey go reach four million euros, the Spanish authorities talk say messi and him Papa dey use Messi image cheat ontop him income from 2006-2009.
na wa o!! pefrson wey look Messi go tink say na angelof God, him sef don enter yawa like many other great sportsmen for past, like Tiger Woods and Beckham dem dem..
dem talk say na him Papa be the main suspect, say na him carry the idea come and Messi agree to am.. poor pikin!! wetin go happen if him go jail?? him go lose all him sponsorship deals and na big yawa be that...

3 comments:

  1. He can't go to jail!!! NO!!!!!!!!!!!!!!!!!!!!!!!!!!

    ReplyDelete
    Replies
    1. NO!!!!!!!!!!!!!!!!!!!!!!!!!!!!!!!!!!!!!!!!!!!!!!!!!!!!!!!!!!!!!!!!!!!!!!!

      Delete
  2. o boy make we see wetin go happen with the case, una go shock!!!

    ReplyDelete