Wednesday 19 June 2013

OAU Girl try Flush Pikin Wey She Born Inside Toilet!!

report wey dey reach our side dis morning na unto one girl for Obafemi Awolowo University(OAU) wey born pikin  for inside toilet for moremi hall block A room 103   . yawa come gas when the girl try to flush the pikin for inside toilet. As of now , we never sabi why the girl go try to flush her pikin wey she carry for nine months,but we be dey reson say her actions na just pure madness because how person wey dey him right senses go try flush pikin for toilet?? e no go fit size am naa , and why him no abort am earlier??
we hear say the girl na part 4 Elect Elect student, waow!! no be efiko she suppose be?? why she come stupid like dat?? some people don react to the whole matta as all of them dey vex ontop twitter unto why poerson go do dat kyn tin!!
 we go dey inform una as the matta dey go. the baby still dey alive



2 comments:

  1. Na wa sha for these my Ogbodo people wey dey this una country here, biko!

    ReplyDelete