Monday 24 June 2013

CHRIS BROWN AGAIN ?

Chris brown accused of assaultThis chris Brown matta don tire me o!!  the guy no get woman joy at all at all, the guy too dey agressive sef. shey him no dey reason say all dis him behaviour go affect him career? at 24.
E be like say na fight him wan dey fight now abi, first na him girl friend dat year, Rihanna, afte,r him and Frank Ocean still fight for car park, the same chris brown don get gbege with Drake wey dat one throw bottle give am for jaw. now him don break one girl leg for night club, doctors talk say the girl fit do operation before the leg go fit dey alright. the boy no dey hear word and e be like say , e go better make him go jail small maybe him head go correct.

0 comments:

Post a Comment