Wednesday 19 June 2013

Police don nabb wizkid and him manager unto fraud

We hear say police for onikan zone 2 command arrest wizkid a.k.a starboy, and him manager. Some unilag students go report both of then join unto say them no show for show wey dem don pay for.
yawa gass wen Wizkid and him manager no call them to explain why dem no show for the show after the UNILAG students don pay dem 500thousand naira to perform for dia sport complex.
we no talk say them lock them up oo!!! na arrest dem arrest them and dem don talk say make dem dey go as investigation dey continue on top the case..
no be today we dey hear say all these artistes go collect money wey dem no go come perform..

0 comments:

Post a Comment