Friday 21 June 2013

how to break up with woman

if you una want smooth break up, make una follow dis procedures

 

1. sharply operate.

anything wey you wan do or tell the woman, do am sharperly!! no waste time dey tink or rehearse wetin you wan talk, talk am straight!! the more time wey you been dey reason wetin and how you wan talk wetin you go take break up, the more fear go dey catch u!! i know say many of una dey fear 'hot water' and 'acid' , nor worry, just do wetin you wan do. God dey with you

2. No go dey worry unto friendship tins

i know say many guys go dey reason to promise the girl friendship unto guilt tins, you no need am!!! just tell and try to dey honest and straight with am. no go dey use am dey do dp for BBM o!! e nor make sense!!
the friends wey you get done do already, move on, give the woman chance make she forget about you.

3. no go dey make enemies oo!!

i know say many of us men no get manners, some of us go yab woman unto say we break up with am, but why?? we no need that kyn situation o!! na wetin make sade pour hot water on top samson head be dat o!!.. just try show small respect, try dey polite, no too shout on top the woman head. take am easy den waka comot. she no gaz become your enemy because you break up with am, apply wisdom.

4. try to stay away from am

na dat time some guys go begin dey change dp everytime, if you no get mind to delete am comot your life, no dey give am chance to dey reason your matta. some guys go come go dey tweet relationship quotes and all those nonsense yarns, guy! you no need am. in fact you fit stay away from all these social media for some time till the whole matta die down. no go dey pass where you know say she dey always dey, no go dey folow her friends dey talk nonsense. stay away!! .. one day you fit just go see am remember some kyn tins make konji catch you join, stay away my brother!

all this procedures wey dey here sef go work for guy wey girl just dump! na still the same process same situation. no how wey una wan do am, pesin must to cry, e must pain pesin so no worry because na just for a while

1 comment: