Wednesday 28 August 2013

I For Date Melvin If To Say I Single- Dillish

BBA winner Dillish Mathews don talk say she for like to date Melvin if to say she single before she enter Big Brother house...

dillih-and-melvin-1

Na everybody been like Dillish well well for this season of BBA, she don already tell all her housemates say she no go follow dem do lovey lovey unto say she don get bobo for Namibia, say she na honest person so she must to stay true to her bobo.

Dillish talk say she no want make the relationship wey she get with her bobo wey dey Namibia to spoil for her hand, say e better make her bobo spoil everything so that she go fit talk say no be her fault.

she talk say she for like to date Bolt sef unto say the guy handsome, but say him too dey talk nonsense.. na how many people she come like?

Shey she even like the bobo sef? with all this tins wey she dey talk....

0 comments:

Post a Comment