This is default featured slide 1 title

Go to Blogger edit html and find these sentences.Now replace these sentences with your own descriptions.

Wednesday, 28 August 2013

Ese Walters: Anoda COZA Accuser Don Show o!

E be like say dis matter no go end anytime soon as many people just dey show from left right and center to talk dem own experience for Pastor Biodun hand o!Dis new accuser don hide him identity so e go hard to confam all the tins wey him talk say Pastor Biodun  and him fellow pastors dey take all dis girls dem eye see.The new accuser talk say him Girlfriend almost fall for inside the pastor trap, say anoda fellow worker for the same COZA talk...

Dem don arrest one fake CNN reporter for Bayelsa

The Chairman of the Nigerian Union of Journalists (NUJ) for Bayelsa state , Comrade Tare Akono, don catch one 36years old man Paul Yempe , him dey claim say him be Cable News Network (CNN) correspondent for Niger Delta region. dem don hand am over to the Department of State Service (DSS) . SSS talk say dem arrest the fake CNN reporter with an Identification card wey be Rivers State Broadcasting Corporation wey dem also dey call Radio Rivers and...

I For Date Melvin If To Say I Single- Dillish

BBA winner Dillish Mathews don talk say she for like to date Melvin if to say she single before she enter Big Brother house... Na everybody been like Dillish well well for this season of BBA, she don already tell all her housemates say she no go follow dem do lovey lovey unto say she don get bobo for Namibia, say she na honest person so she must to stay true to her bobo.Dillish talk say she no want make the relationship wey she get with her bobo...

Afro Candy don invite Beverly Osu to kon show for her next movie

Na wa ooooo , this one funny die . Afro Candy don come out publicly to say she dey willing to offer Beverly Osu a role for her next movie wey dey come soon , unto say how Beverly take do every every for BBA , say Miss Osu get wetin she need for her kind of production . Afro Candy even talk say she for like Beverly to win the BBA contest . We still dey await Beverly response . Shay she go say YES/NO ? See Afro Candy statement below .  ...

Suntai Don Sack Everybody For Him Cabinet

Suntai Don Sack Everybody For Him Cabinet, Come appoint new SSG , and Chief Of Staff.. Taraba State Governor, Danbaba Suntai, don sack all the members of him cabinet, na hin be the first thing wey him go do since he don come back to collect him leadership.The tin wey Governor Suntai do affect all the special advisers, but him no touch Special assistants dem dem.Governor Suntai come appoint Mr. Gebon Timothy Kataes as new Secretary to the State...

Picture: OJB Jezreel dey hospital for India

OJB dey receive treatment hospital for India now , as we report before say him leave Naija for India on 24th of August, 2013.The transplant go happen soon , him dey thank everyone for their blessings and him also talk say make people of Naija continue to pray for am .  We for @9jawetindey wish you well oooooh , you go return back here safely...

Tuesday, 27 August 2013

Six PDP governors wan register theirs new parties .

The Independent Electoral Commission(INEC), on Tuesday talk say dem dey receive like five applications for registration of some new political parties every week. Mr Kayode Idowu , the Chief Press Secretary (CPS) to INEC Chairman, na him tell the News Agency of Nigeria (NAN) for Abuja. The NAN spokesman just dey ask question about the rumour wey dem say six governors of PDP don approach the commission untop say dem wan register new parties . Na...

The original black diamond EFFJAY drop two konfam songs: REGULARLY + ANGELINA

Francis Joseph Ushigiale wey him Stage name be Effjay na 17 year old multi-talented pikin. Effjay get strong passion for music and him sabi play saxophone. Him just drop two songs  titled "Regularly" and "Angelina". Him inspiration na from Oga for music industry like Fela Kuti,Damian Marley,D'banj and Tuface, and for that young age who sabi where music fit take am to. Make una hear am ! ...

Friday, 23 August 2013

Picture : See the last 5 standing for BBA the chase

The big brother africa the chase don dey near its end, as per say e remain 5 people for house . Make we see how everything go end sha . BEVERLY- NIGERIA DILISH- NAMIBIA                                                                    CLEO- ZAMBIA ELIKEM-...

Thursday, 22 August 2013

Picture :See top 10 beers for world

  Unto one product research site we gather the top 10 beers for world .The reports come from FindTheBest na dem gather and filter wetin consumers and experts think about beers across web . FindTheBest CEO Kevin O'Connor talk say the important quality beers suppose get na how the taste be ,another thing be the look ,smell and texture the beer get . ...

Wednesday, 14 August 2013

APC : Igbo president for 2015

One chief for All Progressive Congress , Chief George Moghalu on Wednesday boast say him party go produce Igbo president for 2015.  Chief Moghalu talk say APC dey capable to meet the desires of South East if dem fit produce president from Igbo land. He even talk say the coming of APC go change the face of democracy for Nigeria, unto say government go fit do better for Nigerians to enjoy dividends of democracy...

Wednesday, 7 August 2013

{FOTO} EHYA: Peter okoye of psquare don finally propose to LOLA

  As e dey hot we fit tell una categorically say peter Okoye of p square don propose to lola wey don born two pikin for am. Today for Square mansion na him peter ask lola make she marry am,he even still buy am range rover. As the pictures wey comot be, she don gree to marry am. We just hope say den wedding no go be for Dubai o.  We dey wish dem happy life together ...