This is default featured slide 1 title

Go to Blogger edit html and find these sentences.Now replace these sentences with your own descriptions.

This is default featured slide 2 title

Go to Blogger edit html and find these sentences.Now replace these sentences with your own descriptions.

This is default featured slide 3 title

Go to Blogger edit html and find these sentences.Now replace these sentences with your own descriptions.

This is default featured slide 4 title

Go to Blogger edit html and find these sentences.Now replace these sentences with your own descriptions.

This is default featured slide 5 title

Go to Blogger edit html and find these sentences.Now replace these sentences with your own descriptions.

Showing posts with label Naija politics. Show all posts
Showing posts with label Naija politics. Show all posts

Wednesday, 28 August 2013

Dem don arrest one fake CNN reporter for Bayelsa

The Chairman of the Nigerian Union of Journalists (NUJ) for Bayelsa state , Comrade Tare Akono, don catch one 36years old man Paul Yempe , him dey claim say him be Cable News Network (CNN) correspondent for Niger Delta region. dem don hand am over to the Department of State Service (DSS) .

SSS talk say dem arrest the fake CNN reporter with an Identification card wey be Rivers State Broadcasting Corporation wey dem also dey call Radio Rivers and dem also see am with a fake Identification Card of CNN.

We gather say dem arrest the fake journalist for the office of Commissioner for Energy, Barr. Akio Francis last Thursday.

Wetin make the arrest possible na unto say NUJ chairman, Tare Akono dey Commissioner office dat day.

According to wetin one security source talk , the suspect don swindle some state official before now .

Suntai Don Sack Everybody For Him Cabinet

Suntai Don Sack Everybody For Him Cabinet, Come appoint new SSG , and Chief Of Staff..

gov-danbaba-suntai-taraba
Taraba State Governor, Danbaba Suntai, don sack all the members of him cabinet, na hin be the first thing wey him go do since he don come back to collect him leadership.
The tin wey Governor Suntai do affect all the special advisers, but him no touch Special assistants dem dem.
Governor Suntai come appoint Mr. Gebon Timothy Kataes as new Secretary to the State Government, Mallam Aminu Gika na the new Chief of Staff..

Na only God know the kind levels wey dis matter dey enter o!.... make we dey look.

Tuesday, 27 August 2013

Six PDP governors wan register theirs new parties .

The Independent Electoral Commission(INEC), on Tuesday talk say dem dey receive like five applications for registration of some new political parties every week.

Mr Kayode Idowu , the Chief Press Secretary (CPS) to INEC Chairman, na him tell the News Agency of Nigeria (NAN) for Abuja.

The NAN spokesman just dey ask question about the rumour wey dem say six governors of PDP don approach the commission untop say dem wan register new parties .

Na normal thing for politician to approach INEC say dem wan register new parties , but no be INEC duty to put priority untop any application.

INEC as a political umpire don enter wahala unto registration and de-registration of new political parties wey dem dey see.

Mr Kayode talk say na INEC dey decide untop person wey meet the required standard wey go with the electoral law .

He continue him talk , say the commission dey receive application every week , and say the commission go consider each applicant in accordance with the electoral law.

He kon add say , INEC dey barred to entertain that kind request 90 days before a general election.