Wednesday 28 August 2013

Dem don arrest one fake CNN reporter for Bayelsa

The Chairman of the Nigerian Union of Journalists (NUJ) for Bayelsa state , Comrade Tare Akono, don catch one 36years old man Paul Yempe , him dey claim say him be Cable News Network (CNN) correspondent for Niger Delta region. dem don hand am over to the Department of State Service (DSS) .

SSS talk say dem arrest the fake CNN reporter with an Identification card wey be Rivers State Broadcasting Corporation wey dem also dey call Radio Rivers and dem also see am with a fake Identification Card of CNN.

We gather say dem arrest the fake journalist for the office of Commissioner for Energy, Barr. Akio Francis last Thursday.

Wetin make the arrest possible na unto say NUJ chairman, Tare Akono dey Commissioner office dat day.

According to wetin one security source talk , the suspect don swindle some state official before now .

0 comments:

Post a Comment