Tuesday 27 August 2013

Six PDP governors wan register theirs new parties .

The Independent Electoral Commission(INEC), on Tuesday talk say dem dey receive like five applications for registration of some new political parties every week.

Mr Kayode Idowu , the Chief Press Secretary (CPS) to INEC Chairman, na him tell the News Agency of Nigeria (NAN) for Abuja.

The NAN spokesman just dey ask question about the rumour wey dem say six governors of PDP don approach the commission untop say dem wan register new parties .

Na normal thing for politician to approach INEC say dem wan register new parties , but no be INEC duty to put priority untop any application.

INEC as a political umpire don enter wahala unto registration and de-registration of new political parties wey dem dey see.

Mr Kayode talk say na INEC dey decide untop person wey meet the required standard wey go with the electoral law .

He continue him talk , say the commission dey receive application every week , and say the commission go consider each applicant in accordance with the electoral law.

He kon add say , INEC dey barred to entertain that kind request 90 days before a general election.

0 comments:

Post a Comment