This is default featured slide 1 title

Go to Blogger edit html and find these sentences.Now replace these sentences with your own descriptions.

This is default featured slide 2 title

Go to Blogger edit html and find these sentences.Now replace these sentences with your own descriptions.

This is default featured slide 3 title

Go to Blogger edit html and find these sentences.Now replace these sentences with your own descriptions.

This is default featured slide 4 title

Go to Blogger edit html and find these sentences.Now replace these sentences with your own descriptions.

This is default featured slide 5 title

Go to Blogger edit html and find these sentences.Now replace these sentences with your own descriptions.

Wednesday, 28 August 2013

Dem don arrest one fake CNN reporter for Bayelsa

The Chairman of the Nigerian Union of Journalists (NUJ) for Bayelsa state , Comrade Tare Akono, don catch one 36years old man Paul Yempe , him dey claim say him be Cable News Network (CNN) correspondent for Niger Delta region. dem don hand am over to the Department of State Service (DSS) .

SSS talk say dem arrest the fake CNN reporter with an Identification card wey be Rivers State Broadcasting Corporation wey dem also dey call Radio Rivers and dem also see am with a fake Identification Card of CNN.

We gather say dem arrest the fake journalist for the office of Commissioner for Energy, Barr. Akio Francis last Thursday.

Wetin make the arrest possible na unto say NUJ chairman, Tare Akono dey Commissioner office dat day.

According to wetin one security source talk , the suspect don swindle some state official before now .

I For Date Melvin If To Say I Single- Dillish

BBA winner Dillish Mathews don talk say she for like to date Melvin if to say she single before she enter Big Brother house...

dillih-and-melvin-1

Na everybody been like Dillish well well for this season of BBA, she don already tell all her housemates say she no go follow dem do lovey lovey unto say she don get bobo for Namibia, say she na honest person so she must to stay true to her bobo.

Dillish talk say she no want make the relationship wey she get with her bobo wey dey Namibia to spoil for her hand, say e better make her bobo spoil everything so that she go fit talk say no be her fault.

she talk say she for like to date Bolt sef unto say the guy handsome, but say him too dey talk nonsense.. na how many people she come like?

Shey she even like the bobo sef? with all this tins wey she dey talk....

Afro Candy don invite Beverly Osu to kon show for her next movie

Na wa ooooo , this one funny die . Afro Candy don come out publicly to say she dey willing to offer Beverly Osu a role for her next movie wey dey come soon , unto say how Beverly take do every every for BBA , say Miss Osu get wetin she need for her kind of production .

Afro Candy even talk say she for like Beverly to win the BBA contest .

We still dey await Beverly response .

Shay she go say YES/NO ?

See Afro Candy statement below .