This is default featured slide 1 title

Go to Blogger edit html and find these sentences.Now replace these sentences with your own descriptions.

This is default featured slide 2 title

Go to Blogger edit html and find these sentences.Now replace these sentences with your own descriptions.

This is default featured slide 3 title

Go to Blogger edit html and find these sentences.Now replace these sentences with your own descriptions.

This is default featured slide 4 title

Go to Blogger edit html and find these sentences.Now replace these sentences with your own descriptions.

This is default featured slide 5 title

Go to Blogger edit html and find these sentences.Now replace these sentences with your own descriptions.

Showing posts with label pidgin news. Show all posts
Showing posts with label pidgin news. Show all posts

Saturday, 22 June 2013

how to make your husban/ boyfriend/ fiance parents to like you

plenty women no understand how dem fit make dem husban or fiance or boyfriend parents to like dem, dem tink say na magic. some tins dey wey woman must do to achieve this.

 

1. no carry empty hand go dem house.

whether na party or just ordinary visiting, no carry emty hand go dia o!, u suppose ask your man wetin him people go like. you fit buy schanpps carry go give him Papa if him like to dey shack and you fit buy ankara give him mama, but never ever carry empty hand go him people house. i know say na so so bread some of una go buy , try to step up ur game.

2. no dress like ashewo oo!!

some of una tink say e no mean to open bobby put for ground, your man parents no go support dat kyn tin o!, dem go begin dey reason say u fit go dey knack another man unto wetin you wear, dress like a woman of God if na wetin e go take, no wear skinny jeas wey go dey confuse your husband papa o! just wear normal clothe wey no go expose anything.

3. try to dey friendly with him siblings

no go dey form proud for him parents house, try to dey familiar with him younger ones if dem dey around, try to know more about dem so dem go fit like you. problem go dey if you just sit down for parlor dey look, dem go think say you proud or you no sharp.

4. try to help out for kitchen and other things

as the mama dey stand up to go cook for kitchen , na him you sef must follow. even if you no sabi cook, make dem think say you no useless or say you be spoilt pikin, no wait till dem tell you food is ready or "aunty come chop". try to dey active, try to wash plate wey all of una use chop. sometimes the mama fit talk say make you leave am, no gree o!! na set up! lol

5. finally

you must say thank you well well, you must to kneel down and do like pesin wey get 'home training'. make sure say you dey call dem regularly make dem know say you care about dem too. try to be nice and polite at all times. no go dey squeeze face like foul yansh anytime wey dem come from village come do holliday for una house o..


Tuesday, 18 June 2013

{PICTURE} Pastor give 6 women wey don marry belle for church!

Wonder dem say no fit end, pastor for faith  ministries,Pastor Derek Ngulube  don turn heself to baby factory,e give 6 women wey don marry belle for e church. when dem ask am how he take happen him yan say shame dey catch am to talk. Dem catch am last month na him dey pansh all d married woman wey dey  him church. we sef dey shame for you oooo!


Wednesday, 29 May 2013

Chai! armed robbers don chance pasuma


https://blogger.googleusercontent.com/img/b/R29vZ2xl/AVvXsEic5FZZhKz8frm61iOEXafSjrg1jot14XIE8o2JSpdV5t8E_3aIkjGvaFCRx3CCfMOQzgeIToPvv2SL2nhWybfqczeouGeOoChM1OlTs-ikhHz45vTZ-QQOIPy3-NnggCFRwQXZXCTfbNQ/s1600/pasuma.jpgWe hear say some kyn armed robbers chance Wasiu Alabi a.k.a  Pasuma for Ahmadiyya side for Lagos-Abeokuta Expressway on top monday night.. Dem say the armed robbers collect him range rover sport and all the correct things wey dey him hand like him wristwatch, phone, etc
Punch news talk say the armed robbers come dey drive Pasuma around reach 3hours before dem come alow make him go . Wetin come funny be say, the armed robbers no even sabi say na Pasuma dem chance unto say him just dey hide him face and you know say Pasuma get gold teeth, say make dem no go comot am. 
we thank God say nothing do our Pasuma.
police talk say dem dey investigate the matta.