Wednesday 29 May 2013

Chai! armed robbers don chance pasuma


https://blogger.googleusercontent.com/img/b/R29vZ2xl/AVvXsEic5FZZhKz8frm61iOEXafSjrg1jot14XIE8o2JSpdV5t8E_3aIkjGvaFCRx3CCfMOQzgeIToPvv2SL2nhWybfqczeouGeOoChM1OlTs-ikhHz45vTZ-QQOIPy3-NnggCFRwQXZXCTfbNQ/s1600/pasuma.jpgWe hear say some kyn armed robbers chance Wasiu Alabi a.k.a  Pasuma for Ahmadiyya side for Lagos-Abeokuta Expressway on top monday night.. Dem say the armed robbers collect him range rover sport and all the correct things wey dey him hand like him wristwatch, phone, etc

Punch news talk say the armed robbers come dey drive Pasuma around reach 3hours before dem come alow make him go . Wetin come funny be say, the armed robbers no even sabi say na Pasuma dem chance unto say him just dey hide him face and you know say Pasuma get gold teeth, say make dem no go comot am. 
we thank God say nothing do our Pasuma.
police talk say dem dey investigate the matta.


0 comments:

Post a Comment